E Go Better
E fit be say you bin wan roses, but instead, na thorns you carry. E fit be say you want paper, but wetin you collect na torn. You yearn for joy, but you find despair.
Wen yu dey suffer, e dey like say sadness dey follow yu waka. E no dey follow because e no follow reason, e just dey happen sharp sharp. All of a sudden, you go see say sun and moon dey loner, and sky sef dey darker pass before. The rain wey dey sing before, e just dey like noise now, e dey carry too many tins run for your head. As old mem'ries dey knack yu harder, yu dey sink deep. Even though e be like say everytin don change, nothing really don change. Wen happiness don comot, yu go waka back go the place wey dey lonely and true, the place wey dey make yu no sabi wetin dey happen and dey fear.
Pain dey dance for the tip of change. E dey waka jeje. We sabi say something dey diff'rent but we no sabi say something dey change. Na only when we look back we go sabi the diff'rence between before and now. We no sabi say the moments wey we just live, na dem dey define us. We no sabi say the moments wey we dey live now, naim we go miss one day. Maybe na so e dey be when we dey grow. To know say as we dey grow, tins go dey always dey change and pain go dey follow am.
E fit be say you bin wan roses, but instead, na thorns you carry. E fit be say you want paper, but wetin you collect na torn. You yearn for joy, but you find despair.
You no dey always get wetin you want, but you dey get wetin you need.
Sometimes good tins fit scatter so that better tins fit join together. Every story get one end, but every end dey born new beginning. E go make sense for the end.
One day, you go sabi say you dey thankful to all those wey waka comot from your life so you fit find that one person wey no go commot. Na that pain go dey reason why you go dey fight for your happiness, for beta life, for answers, for closure, and for oda tins wey you no get mind to ask before.
One day, you go dey thankful for the tins wey no work as e suppose because when you don old, sip tea for your wheelchair, you go sabi say everything wey you don go through, e carry you go where you suppose dey and with the person wey you suppose dey with. Na that pain make you become better person and e humble you.
You go still feel pain, you go still lose. You go still make mistakes. But one day, somehow, e go make sense. When e happen, you go dey for different time from the one wey you dey when you dey try understand tins. The pieces fit come together, but dem no go carry the same meaning like when you need understand dem. That "one day" fit no be today or tomorrow; and "somehow" fit no dey the way we want am to be. But e go show.
You no suppose dey look too far for the horizon. Your life no be one grand plan wey dey happen. You be thousands of stories wey dem write together into one book.
One day, you go begin see life without the sadness filter again. E no go hard forever because nothing dey forever. Somehow, life go begin look more beautiful pass wetin you fit remember, and the smell of rain for air go ginger you well well, again. The world dey show us every day say happiness dey all around us, we just no suppose blind ourselves with our own filters.
E fit look like autumn now, but spring dey come, and life go find way. Give yourself time. E go make sense.
Hold on, ehn?
🥺
I really needed this. This is so so beautiful.
And my best line: "You be thousands of stories wey dem write together inside one book".
Jazakumllah Khairan for this beautiful write-up.
May Almighty Allah continue to increase you in beneficial knowledge.
"Somehow e go make sense but that somehow fit no be the way we want. "
Thank you for putting this out.