How far peeps. Make i yarn you something wey happen to me sometimes ago. E get one time like that wey i wan make friends based on the fact say as a guy, you gats to mingle with peeps wey dey for your streets, you get. But e be like say nobody wan gree notice me oo. Everyday I dey complain say people no dey pay me mind. I wear the best clothes, I talk loud but still nothing. E be like say I dey invisible. My friends sef no dey call me again and my colleagues wey we don knack gaari together for school just dey zone me. I dey feel very lonely and unimportant. I even dey soliloquize for night, dey talk to myself say "Why me? Why nobody wan notice me?" But no matter how much I dey talk, ano dey get any answer. person just dey like ghost.
Omo, I no fit endure am again . But na so I decide make I try something different. Instead of dey complain, I con ask myself say why ano start to dey focus on the positive things for my life. I begin to help people and be kind to them. I start to inspire person through the small gift wey God sama me wit, writing. I dey volunteer for my online community and I try to connect with my beautiful with ochara ideas. Life con dey sweet and plum.
The moral of the story na say complaining no go help you get the thing wey you want for this life. You go get your needs by being positive and helpful to others. Also, true and correct happiness no dey come from people wey dey pay you mind, e dey come from making a positive impact for the world. You go feel better about yourself when you dey make other people happy. Shey e don happen to you before? Share your experience abeg
Make una no forget to comment and subscribe o! E go sweet una life like sugar. If una no subscribe, una go miss plenty good things wey go happen for here. E be like say una dey play hide and seek with good vibes. So make una no dey shy, just click the button and subscribe!